Wia dis foto come from, Andrew Matthews – Pool/Getty Images
Read am in 5 mins
Nigeria President, Bola Tinubu and im wife, di First Lady Remi Tinubu, go begin ogbonge State Visit to di United Kingdom on Tuesday, March 17, go reach Thursday March 19 2026, and di British Royal Family don roll out schedule of how di ogbonge visit go be.
Dis na di first time in almost 40 years wey Nigeria President go embark on official State visit to di UK, di last one na former Head of State Ibrahim Babangida for May 1989.
Na King Charles take im hand invite Tinubu for dis visit, and already, im don first host big party for St James Palace, on 12 March 2026, for Nigerian diaspora pipo wey dey live for di UK, in preparation for Tinubu visit.
Di King and Queen go host President Tinubu and im for Windsor Castle.
King Charles imsef, wen e still be di Prince of Wales, don visit Nigeria four times for: in 1990, 1999, 2006 and 2018.
For di 2018 visit, Queen Camilla – who dat time na di Duchess of Cornwall – bin follow Im Majesty come Nigeria.
Also, President Tinubu bin don also visit Buckingham Palace for September 2024, but dat one no be official State Visit, dem bin only discuss issues around climate change for dat visit.
Tinubu UK State Visit schedule
President Tinubu and First Lady Oluremi Tinubu go arrive for di United Kingdom for di afternoon of Tuesday, 17 March 2026, for London Stansted Airport, and dem go dey welcomed on behalf of di King by di Deputy Lieutenant of Essex, Mark Bevan, and by di Acting Nigeria High Commissioner to di UK, Ambassador Mohammed Maidugu.
Den di State Visit go start wella on Wednesday, 18 March, wen di Prince and Princess of Wales – Prince William and im wife – go receive di President and First Lady, on behalf of di King, for di Fairmont Hotel Windsor on Wednesday morning.
Dem go travel wit President Tinubu and im wife to Datchet Road, Windsor, wia dem go receive Ceremonial Welcome.
Di King and Queen go formally welcome di President and First Lady for di Royal Dais, for Datchet Road, as dem go fire Royal Salute for di Home Park for Windsor, and for di Tower of London.
Dem go make presentations and King Charles escort go give Royal Salute, and dem go play di Nigerian National Anthem.
Afta dat, di Nigeria President and First Lady go join di King and Queen, and di Prince and Princess of Wales, for inside carriage procession to Windsor Castle.
For di Quadrangle of Windsor Castle, di carriage procession go meet one Guard of Honour of di 1st Battalion Grenadier Guards wit di Royal Standard of di Regiment, wit di Corps of Drums of di Battalion and di Band of the Regiment, mounted for di Quadrangle.
Di Guard of Honour go give Royal Salute, and di Band go play di Nigerian and British National Anthems.
Den, di President and di King go inspect di Guard of Honour, and afta dat, togeda wit di Prince and Princess of Wales, dem go watch as di King Troop Royal Horse Artillery March Past, di Sovereign Escort Rank Past and di Guard of Honour March Past.
Later for afternoon, President Tinubu and First Lady Remi Tinubu go watch special exhibition of items about Nigeria from di Royal Collection, for di Green Drawing Room.
Following dis, His Majesty Di King go receive di President for audience for Windsor Castle, and togeda dem go visit Vicars Hall, Windsor, wia dem go meet organisations wey dey work for interfaith dialogue nationally and internationally.
Afta dis meetings, President Tinubu and im wife go do private visit to St George Chapel, Windsor, to lay wreath of flowers on tomp di Tomb of Queen Elizabeth II.
For evening, Di King and Di Queen and Members of di Royal Family go give State Banquet for Windsor Castle for President Tinubu and im wife Remi Tinubu.
For di beginning of dis banquet, both Di King and di President go deliver speeches.
First Lady to preach for Lambeth Palace
Wia dis foto come from, @SenRemiTinubu/X
On Thursday morning, di President and First Lady go formally say bye-bye to di King and Queen for Windsor Castle, bifor dem go travel to Westminster Abbey, wia Tinubu go lay wreath for di Grave of di Unknown Warrior.
Den Tinubu go also visit No. 10 Downing Street – di official office of di British Prime Minister Keir Starmer, wia dem go hold bilateral meeting, while Remi Tinubu go visit Lambeth Palace – di official London residence of di Archbishop of Canterbury wey be head of di Church of England.
Dia, she go enta di Chapel for small Service of Prayer, and dem go invite her to preach, bifor she go later join one reception wit representatives from di Church of England and some faith charities including Christian Aid and Mothers Union, wey don dey do some charity work for Nigeria.
Las las, President Tinubu and im wife go join body to go and watch di Nigerian Modernism exhibition for Tate Modern, and also attend reception wit members of di Nigerian Diaspora for di UK.
Tinubu and first Lady Remi Tinubu go depart from di UK for evening of Thursday, 19 March 2026.

















